99.5WAZOBIA FM: AMEBO ZONE:- My friend wey bin dey school for - TopicsExpress



          

99.5WAZOBIA FM: AMEBO ZONE:- My friend wey bin dey school for Cyprus jus come back to Naija after 4years away. Since him come back, my otepu begin dey behave somehow, I don ask her if anything be d problem she say no. Now I come arrange make my friend come meet me for haus say my fiancée dey around. To my greatest surprise, my friend come say my fiancée na him otepu wey bin dey misbehave before him travel from Naija be that. Me and my friend na childhood friends we be and for years we bin no see each other before him travel. Now my otepu no tel me anything about this guy she only say her ex no dey Naija again. Now we dey engaged and my friend say him sti like her and me like her too and the otepu say na me she wan dey with but my friend no wan agree. Abeg wetin be the way forward here o? LADYG D’GENIUS (@ladygdgenius) and OCHE D’KING (@ochewazobia) DEY IN DA HAUS….
Posted on: Tue, 11 Jun 2013 16:05:01 +0000

Trending Topics




© 2015