ASUU STRIKE ADVERTISEMENT!!! Yes O! E don happen again o. Chukwudi - TopicsExpress



          

ASUU STRIKE ADVERTISEMENT!!! Yes O! E don happen again o. Chukwudi Films in association with Chukwuemeka Pictures present anoda ogbonge movie ASUU STRIKE 2013. Dis one na movie wey pass movie o! Dem no dey tell person dis one o! U must to watch am by urself & for urself. Come hear the true story behind the whole ASUU Strike. Who start am, why dem start am, who suppose end am and who no gree end am! U go c all for dis movie. Money don scatter our country o! Dis one dey ask 4 money, dat one say no money...ewoOoooo! Chai! Come see as University students dey suffer, see as crime don dey increase, girls dey born like fowl, yahoo men dey press die, see as lecturers kukuma don turn house/lesson teachers & some dey roger kabukabu wt dia moto...See Blood! See Blood!! See Blood!!! Rich men no worry. Leaders no even send. Wetin poor man go do. Kai! ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . . Suspense full am, intrigue, romance, swagger, ginger...dat will keep u glued to d edge of ur seat. U go laff, u go cry and u go reason sef. ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . . Grab ur copy now! Starring: Kanayo O. Kanayo as Goodluck Jonathan, Pete Edochie as Nassir faggie, Patience Ozokwor as Ngozi Okonjo-Iweala, Eucharia Anunobi as Prof. Ruqayyat, Ahmed Rufai and Olu Jacobs as Gabriel suswan & Prof Julius, Okojie, Jim iyke as Yahoo boy & Saka as poor man o! ASUU STRIKE 2013! Grab ur copy now!!!!!!!!!!!
Posted on: Tue, 24 Sep 2013 04:34:58 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015