BAD MARKET:::; 1. Bad Market is when you go in front of - TopicsExpress



          

BAD MARKET:::; 1. Bad Market is when you go in front of White Garment Church to sell shoe or slippers,... I ask you, Cele- church dey wear shoe. 2. Bad Market is when you dress to go church come wear PINK top with BLACK skirt/trouser, but as you bounce enter church, you come see say na dat your colour una Church Choir wear dat sunday. As you come siddon for back, people come dey look you as one Choir member wey dey under suspension. 3. Bad Market is when you chop the only fish head (isi- azu/ori-eja) wey remain for pot of soup, without knowing say na that fish- head your Malleh wan take arrange nite-food for your Palleh.... My dear, na that nite your Papa go disown if you no vomit that fish- head. 4. Bad Market is when a lady dey sleep come dey dream where she dey give birth for hospital bed. The nurses come dey tell her pussssssssh, she just dey push dey go. When she finally woke up, she come see say na shit she dey shit for bed. 5. Bad Market is when you as a guyman, ask a girl to give you her number after toasting her, she come give you her papa number. You come decide to call her at midnite for romantic chat... My dear your name go turn to "error in connection". 6. Bad Market is when you don arrange your room finish, come lie down on top of bed dey wait for one chikala wey you invite to your house. As you hear knock on, naso you rush as sharp guy go open door thinking say na your latest chikala, you come see say na your Landlord wey you dey owe 14months house rent. 7. Bad Market is when you mistakenly use weed (igbo leaf)cook jellof-rice thinking say na scent leaf or curry leaf... My dear, na Fela or Bob Marley go wake you up for New York when you eat the rice finish
Posted on: Fri, 26 Jul 2013 12:42:55 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015