DONT FOLLOW THE CROWD WAPSMART AND NKIRU Nkiru : Oga smart - TopicsExpress



          

DONT FOLLOW THE CROWD WAPSMART AND NKIRU Nkiru : Oga smart good morning i come here on saturday granny say you still dey sleep. Wapsmart : nah me tell her say if anybody come looking for me she should tell the person say i dey sleep Nkiru : well. You don hear the bad news Wapsmart : which news you no say light no dey una abeokuta again Nkiru : i never get my self since i hear the news on friday Wapsmart : wetin happen now Boko haram don bomb ur house abi the missing malaysian plane don land for yah compound Nkiru : msteew, see ur mumu mouth if boko haram bomb my house , che hin no go affect your house abi your house get odechi Wapsmart : chei, nkiru na me u dey call mumu, nah rat go chop that ur mouth. Nkiru : well i come tell you the club dem pair with man utd for champe. *nkiru walking away* Wapsmart : Nkiru! Nkiru!! Wait now, tell me now Nkiru : ehn i don wait, i no go tell you again Wapsmart : tell me now, who dem pair with manchester united nkiru : hahahaha lolx. Oga smart no disturb me jare, ah wan go drink ogidiga for mama ochuko shop Wapsmart : why u dey show me your dirty teeth, and which one be ogidiga again, for dis sunday morning, yarn me now who dem give man utd. Nkiru : if i yarn you who dem give you, you go faint Wapsmart : haha. Me faint, tufiaka since dem born me ah never faint talkless of daku Nkiru : just know say u no dey for champions league again Wapsmart : kilode?? Nkiru : no be that club wey dey beat anybody anyhow dem give you, no be dt club wey dey run around like a roaring lion searchng for d team to destroy dem give you. Wapsmart : abegi.. U too dey talk. Dem no get name? Nkiru : na bayern oh. Bayern munichI. Man utd don die. Wapsmart : woa, woa, *wapsmart jumping, laughing* Nkiru : oga smart hin be like say sumtin dey worry u.. Wapsmart : yes oh.. Me happy ni.. Bayern munich nah man utd pikin now Nkiru : abegi hin be like say u never wake for ur sleep.. I say Bayern munich na hin dey give u.. Wapsmart : ehn wetin con happen Nkiru : dem go waya you ni. Wapsmart : abegi forget who dem wan waya. All dis one wey u dey tink say bayern go flog man utd because say man utd dey play worse abegi forget that one. U no see wetin happen for Goliath for Bible. No be small but mighty David kill am, ehn che david fight am, ansa me, no be stone hin throw abegi no dey think that way joor, though man utd dey play worse even the dead no that but that no means say dem don famuse for champions league. Abi with all d pressure dem put for David sey hin no fit kill Golliat, che David no kill am. No be 180minute we go play.No dey follow d crowd, no dey tink sey bookmaker abi wetin dem call dem write am say man utd go loose abegii forget. No be for battleground David settle the scores with Goliath. No be for field them go play the match abi nah for ontop paper abegi nkiru go sleep oloote oshI. Nkiru : hmmmmmm hmmmm *nkiru nodding is head like lizard* Wapsmart : nkiru, u don turn to lizard why u dey nod ur head? Nkiru : nah true you talk oh, but no be that maluu(man utd) go beat Bayern munich Waspmart : abeg ah wan go brush i dey go church, go drink you ogidiga *bye* === Food For Thought (Never Follow the Crowd) Never follow the crowd because when you are following the crowd its only those who are at the front can see clearly, Never let people put fear in you that the task you want to embark will be a fail one, never let people pump pressure into your heart just because they couldnt do it. Those mighty man was unable to kill Goliath and when David wanted to, they try to put fear in him that he cant do the impossible just because they couldnt. Someone doesnt succeed doesnt mean you cannot. People might whisper into your hear that the mission you are about to beging is mission impossible come on my dear never panick why dont you take that step and take the risk. Where others failed David succeed there. Take that bold step and never allow the multitude to hoodwink you that you cannot do it. Close your eyes to what you are seing, never listen to what you are hearing because if David have consider the big Goliath and listen to what others are saying, he would have decided to opt out but rather he have that believe that he can succeed where others could not. Have faith in him(God), believe in yourself and that mission impossible might turn to MISSION POSSIBLE.. Good Morning and enJoy your day (sunday) Abidemi Victor Rasaq wapsmart
Posted on: Sun, 23 Mar 2014 08:33:50 +0000

© 2015