Dear Omasan Nah me your guy Ejiro I don land spain oh make you - TopicsExpress



          

Dear Omasan Nah me your guy Ejiro I don land spain oh make you help me thank God,the waka no be small but man no die man no roten ,I dey with some waffy guys for here maybe you know one of dem him name Tuoyo him sef na "sheke" boy and him mama dey crayfish for kpesu market I still dey try arrange mysef but dem tell me say make i cool down find one whitey to marry so if you see my pic for Facebook with whitey no vex becos na to survive and when I get my papers finish I go send money for you to try arrange visa becos the waka wey I do go too strong for you since you be chief pickin(she smiles) ok nah make I waka the guys wan go clubbin this evening and na for there person fit jam correct Tell all the people for our coumpound wey dey talk say i no go fit make am say "the devil is a liar" I don reach europe and tell Ufoma say i no get her time again all that yanga wey she dey do becos her broda dey canada na for nothing you fine pass am 100 times even though she don dey tone to look like oyinbo nothing for am you be black beauty the natural stuff and na dat me i like Ok nah make I waka ,abeg no tell my papa second wife pickin dem where i dey if dem ask you jus tell dem say I dey spain the woman get bad mind for me since na me be the first son and na only girls she born take care I go wire you someting soon give me small time your guy Ejiro Atiyota 223 Plaza des Fuentes Apt 15b malaga Spain ps abeg no use dis address na only letters we dey recieve there my real place no get address
Posted on: Thu, 29 Aug 2013 08:19:09 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015