Dis Naija dey make me laff Na only for Nigeria you fit win - TopicsExpress



          

Dis Naija dey make me laff Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading N200 MTN Recharge Card. Very soon Etisalat go say recharge N200 and win a big ship. Then Airtel go com follow sey, recharge N100 and win Benin Republic. Glo, go just kuku say... Recharge N500 and win Nigeria bcos their colour na Green. Na only for Nigeria you go see fish insideMEATPIE Na only for Nigeria you go see garden egg inside EGG ROLL Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines. Na only for Nigeria PHCN dey sey:- Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (wat a pity) Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green. Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff and beer. Wetin you u no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world... Trust me. It is only In Nigeria youll find a graduate of Mechanical Engineering doing his NYSC in a Police station. It is only in Nigeria that one person is using Bold5, X3, Ipad2 and Nokia N8 all at once.You be Bill Gates? Abi na you invent internet? It is only in Nigeria that you will see a graduate of law working as a generator repairer. Na 4 only Naija, you go see madman dey control traffic, people wey their head correct dey obey... Na 4 only Naija, driver dey blow horn for traffic red light make a quick turn to Green. Na 4 only Naija, wey you go see the president senior the country itself. Na 4 only Naija, you go see advert from native doctor on how to make quick money. Na 4 only Naija, NEPA go give you light for one day in a month yet you pay bill of one month. Na 4 Naija obituary postal dem go say MAMA HAS RELOCATED
Posted on: Wed, 21 May 2014 19:04:26 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015