E get one particular restaurant wey i dey chop 4 GRA, E get one - TopicsExpress



          

E get one particular restaurant wey i dey chop 4 GRA, E get one oyibo wey dey always come chop there too... Any tym dis oyibo chop finish he go shout Hey, so I wonder wetin dey make am shout, i decide to chop wetin d oyibo dey always chop so maybe me self go shout too.. when i reach d restaurant last wk friday, i order wetin d man dey chop.. Dem tell me say na chicken & red wine, so i chop am, but i no shout, i colet xtra plate, but i stil no shout.. na then i just vex ask 4 my bill. D waiter tell me say one plate of chicken & red wine na N75,000 then d xtra plate na another N75,000.... na then i shout heyyyyyy heyyyy heyyyy heyyyyyyyyyyyyyyyy,I still dey shout till now..
Posted on: Mon, 11 Nov 2013 22:06:31 +0000

© 2015