I LOVE NAIJA I NO GO LIE!!! God Bless Nigeria!!! Na only for - TopicsExpress



          

I LOVE NAIJA I NO GO LIE!!! God Bless Nigeria!!! Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading N200 MTN Recharge Card. Very soon Etisalat go say recharge N200 and win a big ship. Then Airtel go com follow sey, recharge N100 and win Benin Republic. Glo, go just kuku say... Recharge N500 and win Nigeria because their colour na Green. Na only for Nigeria you go see fish inside MEATPIE Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines. Na only for Nigeria PHCN dey sey:- Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (what a pity) Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green. Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff and beer. Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in the world... Trust me. Na only 4 naija you go find a graduate of Mechanical Engineering dey do him NYSC for Police station. Na only 4 naija you go see one person dey use Bold5, X3, Ipad2 and Nokia N8 all at once.You be Bill Gates? Abi na you invent internet? Na only for Naija you go see a graduate of law dey work as generator repairer. Na only for Naija you go buy Coke, dem go say make you no forget to return d bottle. Na for only Naija, you go see madman dey control traffic, people wey their head correct dey obey... Na for only Naija, wey you go see the president senior the country herself. Na for only Naija, you go see advert from native doctor on how to make quick money. Na only for Naija you go wish somebody happy birthday, he go answer same to u. Na for Naija obituary poster dem go say MAMA HAS RELOCATED Na for this country Lawmakers dey climb fence and Police dey fire teargas at big men. Hey Naija! Come see Roundabout plus traffic light plus police and Karota for Kano or Zarota for Gusau for drivers to obey rule. .. im proud of this my country we dey unique. I don too see for my Papas land, Nigeria I hail thee. I don dey compile list to write a book about my great country 9ja...
Posted on: Tue, 23 Dec 2014 06:22:00 +0000

© 2015