MY FRIEND YOU GO MAKE AM ! If TECNO fit ping before NOKIA, Na - TopicsExpress



          

MY FRIEND YOU GO MAKE AM ! If TECNO fit ping before NOKIA, Na who tell you say all your mates wey start work before you go fest you make am? If CIVIL DEFENSE fit carry gun before ROAD SAFETY, who tell you say na by how far? My guy, na by how well ohh...!!! If GARRI fit sell pass INDOMIE after all the adverts, my sister who tell you say you must wear the most expensive cloths or dey naked to attract men? If Oga JONA weh no get shoe before fit wears 3 different shoes per hour now, who tell you say poverty na your name? Over hope dey jareee.. If them fit tie cow with rope upon him size but must use chain to hold dog follow body, who be that wey dey tell you say you no get size? If 2face fit finally marry one woman (Annie) who tell you say your current boyfriend/girlfriend no go marry you? Abeg, gum body give am. If Judas fit sell bro J his boss, upon all the miracles, who tell you say that your best friend or lover no fit sell you?.....be careful! Finally, I know say youre gonna make am. So keep believing in yourself for every man is made and allowed to thrive for a purpose. As we gradually approach the end the year 2014, May God put an end to all your challenges and open a new gate in your life IN JESUS MIGHTY NAME. AMEN Goodmorning Palsssss
Posted on: Tue, 04 Nov 2014 09:49:40 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015