OKAY LADIES.......ma ke una open ur 2 ears wide open and hear - TopicsExpress



          

OKAY LADIES.......ma ke una open ur 2 ears wide open and hear wetin i wan tell una as e be say una no dey understand english, i go talk am 4 pigin... NOTE: Na only pidgin make una take respond no be every man wey dey drive car get money. Some of dem be driver, sum na their papa car, sum na their friend car, sum na their neighbor car, sum even steal the car sef. Becareful make them no catch u inside car with armed robber bcos na only man wey get car u wan follow. Marriage no be by force, if man say him no wan do again, make una no threaten 2 kill am. Like that woman wey chase her bobo with knife enter police yard, now na kirikiri she dey chop meal. u say u no fit follow small boy, Shey u don 4get say dat aristo wey u dey follow 2day na small boy him sef be yesterday. No dey look down on those bobo wey dey toast u 2day, u no know wetin dem go be 2morrow. No be every girl wey stand 4 road be ashewo. If u open leg bcos u dey expect brazillian hair, blackberry ,gucci bag, prada perf or pocket money after the action u sef be ashewo, try dey take urself out small, even if na mama put. That way una no go dey order like Oliver Twist wen him carry una commot. dey try spend small 4 ur man, no be say na just 2 dey collect 4rm am una sabi No think say all boys wey toast u come 4 marriage. dey wan study u b4 dey 4 fit talk of marriage. Man wey dey find wife no go take u serious if u put pancake 4 u face like drawing board and wear cloth like say the material no reach. Na only bf u fit find with dat kin look. If u wan marry, begin dress and act like wife material no be like ashewo 4 allen....U no need for advertise your body...belive me the man dem know how it be...u sef dey try buy small small thing 4 ur man even if na small body spray. Shame no dey catch u if na just 2 dey collect 4rm am.... Make you uphold you dignity and no let one raggidy useless bobo com dey talk to U anyhow cos him dey give you chiken change.... U are beautiful, fearfully and wonderfully made in the Image of the Almighty...no sell yourself short jooooor...
Posted on: Tue, 15 Oct 2013 18:45:42 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015