Omo me lo fit laugh alone oh...hehehe.. Before Brazil and Germany - TopicsExpress



          

Omo me lo fit laugh alone oh...hehehe.. Before Brazil and Germany match na so two of my friends..Tolu and Hammed don bet say for every goals scored na one Slap.....see me see trouble.... tolu choose Germany and hammed wey dey fast go choose Brazil... yeepa see thunderstorm slap wen germany score the first goal na so I hear Gbaoooo for hammed Ear... my guy package himself him talk say brazil go soon score ...next tin I just dey hear rhetorical 4slaps in 6minutes...na so hammed begin to dey vomit the food wey him use break oh.. see trouble..... before first half end hammed don reach General hospital.... second half start na hospital we still dey as schurrle hammer him goal enter na soo tolu dey run come with another miraculous slap for hammed ear....GBOOOOAAAAAAHHH...Yeeh na so hammed faint oh.... within like 3minutes later wey germany score there 7th goal as tolu dey run come as usual guess wetin happen ................????? Na gboaaaaaaaaaaa again chai hammed don die.....huh......after match na police station tolu meet himself...Ehn.... Germany dia is God oh.. see what u av caused.. the goals u are sharing in brazil Ehn God go ask oh.......
Posted on: Wed, 09 Jul 2014 12:59:31 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015