P.M News/Updates. 29/4/14 Dem don advise the people of - TopicsExpress



          

P.M News/Updates. 29/4/14 Dem don advise the people of Urhobo say make dem maintain close ranks and make dem get unity of purpose to ensure say the Urhobo nation restore e place of pride for Delta State and Nigeria at large. Na The National Chairman of the Urhobo Political Forum [UPF] Chief Ighoyota Amori nai give this advice recently for Ovwian wen dey Udu LGA during the inauguration of UPF ward Executive in the Council Area Report come from Mission Rd today thru the Okorlokor bird wey we send go attend the meeting for Mission Rd. E say d outcome of d meeting, na say message reach d Landlords of d Aiyetan area say OMOLUBI go meet with SEPLAT representative say na him be d Leader of d area and Youth Leader of Itsekiri Nation and say b4 SEPLAT go do anythin for d Oil well, say dem must come see him and Settle him and him go in turn go settle all d Landlord for d area. The meeting end with quarrel base on say who go go represent dem as dem disagree on who dem go send go SEPLAT, as e nor wan gree go. I dey shame for unu as unu nor bold and na so,so noise unu dey make. Report come from Tafia Elengoro dis morning say BEDC workers dey protest dis mornin say d woman incharge don sack almost half of d workers. All d worker put on red shirt dey protest dis morning 4 AT&P gate say d woman dey oppress dem, say make d woman go back 2 Union Bank wen she 4 cum. D mata wen dey ground now be say, if d Funke wey be d woman begin sack almost half of d field workers, who go cum dey do d work? Madam use ur head oh. Report run enter studio thru CCTV say Pius Leggy Broda Ufeoma wey we popularly known as Big16 wen dey do Bouncer for Mega Planet go rape one fine Babe and na Mama G Daughter. As we dey look d matter so dem be two wey go pull d shit but dis Agbalagba nor wan talk well. Report cum from former Palace Hotel say the family dey ready to throway special burial to deir wonderful father as Late Smart Ogbimi na respectable Chief for the Okpe land. As we dey talk so na everyday nai the family dey play host to Okpe group of drummers and dancers. Them dey deny d pressing of Bobby as dem say na deir wives dem dey press but i put am to dem say dat na big lie. Report show from Ekpan side say some Chief from Warri dey discuss the carry do of Francis Maku as dem frown say at dis era wey e senior pikin (daughter) Judith Maku dey plan marriage with Mogbejule Luckh nai Francis Maku still dey born for outside e home. From studio we join voice with the Warri chief dem say Francis Maku cordinate ur manhood or else you go dey born ur children go dey born. Dat na life,ehn Itsekiri Micheal Jackson? Report cum from Sele Bonga say one serious accident happen for Olympia dis evening as one Taxi jam one bike man scarter. Na dem Johny Gsm and some good samaritans nai settle d issue as them cos better Traffic for Olympia couple with pipo wey dey lock tyre as dem lock pipo motor tyre dey collect bribe to free some defaulters. Salvation Clinic don turn one of d most dirty Clinic for Sapele. All d clinic dey smell dun like wetin dem nor dey mop with dittol. All d nets don tear finish and mosquito don dey use some patient dey gym for their. Dr. Afoke, d only better tin wen u get for dat Clinic na d inverter. Try utilize d high bill wen u dey charge pipo to make ur clinic neat oda wise, we go use NAFDAC take seal up ur clinic. BEDC, unu don dey side line some parts of d town with unu evil raction. D 4 hours wen unu dey give from Olympia go jam Ugberikoko, nor dey correct again as na so, so Ogwanja area nai dey enjoy d lite. Make unu adjust dis unu ration policy and make unu dey allow d 4 Hours dey correct. MAKE I GO CHOP REAL MADRID BREAD AND I GO DRINK BAYERN MUNICH MINERAL TAKE TOP AM. God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER
Posted on: Tue, 29 Apr 2014 18:53:28 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015