PSALM 23 IN PIDGIN ENGLISH 1. The Lord na mai Shepherd, I dey - TopicsExpress



          

PSALM 23 IN PIDGIN ENGLISH 1. The Lord na mai Shepherd, I dey kampKe 2. He make me sidon for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi Thermacool. 3. He panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness for sake of Hin Name. 4. Walahi! If I waka pass where arm robber, 419, and juju people borku, come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko? Na so them dey like back bone dey comfort me. 5.You don prepare Banga and starch make I chop. All my enemies dey look anyaya. You rob me for head wit Vaseline Intensive Lotion. My cup na Ogunpa River wey come overflow hin bank. 6. True, true, betta life & mercy go gum my back till I quench. And man go tanda for God house sotey sotey from Lai lai to lai lai. GOD ALMIGHTY, NA YOU BIKO. AMIN!!
Posted on: Mon, 17 Jun 2013 16:56:38 +0000

Trending Topics



style="min-height:30px;">
PT. AT Indonesiais a joint venture between PT. Astra Otoparts
Right now I dont feel anything, Thinking about a lot, If i come

Recently Viewed Topics




© 2015