SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. As i dey so,i nor wan talk bad - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. As i dey so,i nor wan talk bad of anybody becos dis na yulitide period according to Obodoyibo people. I beg who ever know say e know Chief Barr Charles Obule,make unu go tell Chief Charles Obule say make e nor try me spoil Ugbeyiyi Road wen Govt just begin dey do so,after we don cry for decade from dis Forum. E dey use big big Tippers dey carry red Sand since 3days back now and just day befor yesterday, one of d Tipper spoil d Road Yesterday wen d Tipper run enter gutter come spoil near where dem for dey sell fruits for there and now where d Tippers dey pass enter where e dey fill so , don dey spoil dey go. The gutter slab don break too, na so e do some years ago wey make d Road spoil and E Don start again.If na d stroke wen e get dey affect am make unu tell am mak e go e Hospital for Okpe Road. As d people wen dey do d Road dey there, make E just quik go tell and beg, make dem amend d places wen d Tippers spoil. E nor shame wen e tell d people to arrange e front of House wit beta Cota becos of e pikin Marriage wen e wan do, and after e don spoil d road finish, e go run go PH. If nor be say we cry loud out wen Govt come hear our cry,dis Obule wen no fit renovate e Late Father Compound,or pack e family wen get Kolo go Hospital, nor fit do d road and na front of e house na d road for spoil pass. See am nor be so so cry we go dey cry make Govt cum do our Road and One Money Miss Road go cum dey spoil am,wit Tippers wen dey carry Red Sand. Na beg i dey,mak unu go look d place wen dis Tippers dey pass so, unu go vex pass me for Obule. You dey PH dey throway money and ur Houx wen dey Sapele nor get better Road,u nor fit shake body,after u go dey donate big money for Churches Harvest,throway big money for Elections and u dey shout say u be philanthropis yet i norva see d pipo wen u don helep and na soso ur Wife dey waka round town wit Escort. Na so one of ur Mopol go flog one Okada Man for Cementary Rd,just becos e park dey carry passenger. Mak u thank God say my head dey Houx dat day,if not i for Jail dat Mopol for assault. Anyway wen u wan do am,just go find solution to dat Road,becos Road wen dem for get Big Man wen nor dey behave like big men nor worth our regard. E get one small tin for dis Forum befor wen u dey pay money to dey defend u,i dey wait mak e cite come out cum talk,if i nor site pepper for e eyes,nor be me. If we dey count better leaders for Sapele ur name nor fit enter 1 to 10 again,becos u don too ova fall ur hand. Okpe Man wen u be,na outsider and stranger nai u go cum dey wait for to press effort to arrange ur Road for you. I throway hailings give Adam wen be former Koko Chairman wen put leg for Desopadec and Oil,if nor be him many Roads for Ugbeyiyi Axis for norva see light of Repair at all. Wetin unu wen be Okpes wen big for Ugbeyiyi dey do? Mak i norva talk go UPU President side first becos e own day dey cum. See Shell Rd as dat Road bad reach dat time,na so all unu just dey waka pass d place,and unu get better money to repair the Road or even use unu connections take draw Government attention to d place,yet unu all pack face,until Hon. Godwin Ebosa cum single handedly repair d Road up to e front and after where e office dey. Na so beta leader suppose dey do,nor be to dey pack Soldiers full body,dey spend money for Security for where e for nor neccessary,instead of u to use d money tak affect the life of people wen dey around u. Mak i even ask unu self say WETIN WE GO REMEMBER UNU FOR,IF UNU DIE? I just dey naff. Unu wen call unuselves Government wen dey do dat Ugbeyiyi Rd,wetin unu wan tell us say unu dey do? Why unu dull like dis self? Amany times unu go repair dis same Road under dis same condition and e go spoil again? If we know say we want mak that Road last well for all of us to use,mak we by now start to dig GUTTERS for d 2 side of d Road so dat water nor go affect the Road again. As unu go open eyes for dis modern era dey do Road wen nor get Drainage? Na dsame rope wen tie Ugbeyiyi Rd nai tie Gana Rd,Shell Rd and as i dey look am this roads nor go last at all. And body dey tell me say na to chop money nai mak unu dey leave d Roads without drainage,so dat unu go dey see where unu go for dey eat more money. URHOBO VOICE MAGAZINE say IF U NOR FIGHT UR FIGHT,NOBODY GO FIGHT AM FOR U. Na Sapele and Delta State fight nai i carry put for head,becos na better tin nai person dey fight for. Obule! Obule!! Obule!!! Amany times i call you? 3Times,if u be better person,as ur Daughter wan marry now,and Govt don helep u repair Ugbeyiyi main entrance,u for throw ur weight for Akpoisi Drive mak dem repair am too,becos ur Pikin Marriage, Traffic go disturb Ugbeyiyi main Road. If u know wetin good for you just go repair where ur Tipper spoil if not i promise u say i go use Ghost Mode tak cos Havoc for dat junction and u go regret am wen u go later find out say na me cos am. Becos Turaki Of Adamawa Former Vice President Abubakar Atiku nor go fit pass enter,as na him be ur Chairman. Mak i nor too talk,becos where i march dis morning one Mr Edeh Azigbo go put leg for d place near my grave,nai electric shock am. If ur mouth nor strong, nor challenge me,becos na who get Fact i wan shock wit d voltage wen dey my body,wen fit put light for d whole of Sapele. WEY DEM,WEY DEM? Na me Otota1. Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. Eagle eyes of Delta State dey talk. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 04 Dec 2013 05:30:18 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015