*SPORTS TREK 23/01/2015 Chimezie Amanfor wey be Enyimba - TopicsExpress



          

*SPORTS TREK 23/01/2015 Chimezie Amanfor wey be Enyimba striker don tok say d Super six tournament wey go soon begin shele go serve as better preparation for d continental match dem go get against Beninese side, Buffles du Borgou FC . D Federation Cup winners go den struggle for d game with champions Kano Pillars, Dolphins, Warri Wolves, Flying Eagles and Dream Team VI for d annual pre-season championship wey go lass for one week for Abuja. Amanfor don tok say even if de no win d competition, e go helep dem prepare for d match against dia Caf Champions League opponents Buffles du Borgou FC. D LMC Super Six tournament go helep us get enough training for our continental match against Buffles du Borgou FC of Equatorial Guinea. D tournament go tough for us to win as we fit no dey 100 percent ready wen you compare am to our opponents wey do better preparation dan us. Naso D former Akwa United attacker wey yarn Our studio tok say he side no go carry lass for d game. D Peoples Elephant go begin dia Caf Champions League match for home ground during d secon weekend of February for Malabo against Buffles du Borou FC. Samson Siasia wey be head coachi for d Naija Under-23 football team don name he 21 players wey include Oghenekaro Etebo and Tiongoli Tonbara to face Tunisia for d two pady pady game wey go shele for Tunis. Etebo dey tap ball for Warri Wolves while Tonbara dey for Bayelsa United book, na d game d Naija Under-23 team go take prepare for d All Africa Games kwalifayas . Siasia kon tok afta he don show de public de list say players wey hin don select bin get dia chance by merit as na only d players wey show beta swagger for d training wey d team do follow for d list. Also for d squad be Bendel Insurance left-back Obanor Erhun wey don train with de Super Eagus bifor, others for d list be Ewenike Achibi Chibuike, Freedom Omofoman and Sunday Adetunji, all from NPFL clubs. Na d full squad be dis. •Goalkeepers Daniel Shinkut, Abiodun Asimiyu, Yusuf Mohammed •Defenders Okorom Stanley, Obanor Erhun, Oduduwa Segun Tope, Sani Faisal, Amuzie Stanley, Sincere Muenfuh Seth •Midfielders Azubuike Godson, Effiong Etim, Obochi Eneojo, Godwin Amunde, Ewenike Achibi Chibuike •Forwards Odibo Godwin, Tiongoli Tonbara, Omofoman Freedom, Etebo Oghenekaro Peter, Ajayi Oluwafemi Junior, Adetunji Sunday, Peter Onyekachi Samuel Real Madrid go chop knuckle wit Norway midfielder, Martin Odegaard as dem kolobi am from Norway club Stromsgodset as soon as hin pass medico tins. D club yarn say dem go sign de 16 years playa afta tori bin shele for Spain papers say dem don drop €3 million for d smallie. Na on Thursday dem go do he naming ceremony for d club training ground dey club yarn for dia website (realmadrid). Odegaard bin play he fes match for Stromsgodset wen he be jus 15 years and now he swagga and sabiness don make big big ogbonge clubs like Barcelona and Bayern Munich dey eye am. He come become d youngess eva playa to wear Norway short tap ball wen hin play dia match wit United Arab Emirates wen he be 15 years and 253 days for August time come break rekod wey don tey pass 100 years. English FA Cup Today by 8:55 PM - Cambridge United vs Manchester United English FA Cup 24 Jan. 2015 1:45 PM - Blackburn Rovers vs Swansea City 4:00 PM - Birmingham City vs West Bromwich Albion 4:00 PM - Cardiff City vs Reading 4:00 PM - Chelsea vs Bradford City 4:00 PM - Derby County vs Chesterfield 4:00 PM - Manchester City vs Middlesbrough 4:00 PM - Preston North End vs Sheffield United 4:00 PM - Southampton vs Crystal Palace 4:00 PM - Sunderland vs Fulham 4:00 PM - Tottenham Hotspur vs Leicester City 6:30 PM - Liverpool vs Bolton Wanderers Spanish Lali Ga 24 Jan 2015 4:00 PM - Cordoba vs Real Madrid 6:00 PM - Elche vs Barcelona 8:00 PM - Atletico Madrid vs Rayo Vallecano 10:00 PM - Real Sociedad vs Eibar 10:00 PM - Villarreal vs Levante Italian Serie A 24th Jan. 2015 6:00 PM - Cagliari vs Sassuolo 8:45 PM - Lazio vs AC Milan French Ligue 1- 24th Jan. 2015 5:00 PM - Lille vs AS Monaco 8:00 PM - Bastia vs Bordeaux 8:00 PM - Evian Thonon Gaillard vs Toulouse 8:00 PM - Guingamp vs Lorient 8:00 PM - Montpellier vs Nantes •TENNIS Italian paddy wey dem dey call Andreas Seppi use shockwave take land the Australian Open on early dis morning as he win four-time champion Roger Federer. Na Ranked 46th nai Seppi be for the world and the 30-year-old Seppi beat Roger Federer hands down with 6-4, 7-6(5), 4-6, 7-6(5), under the looku looku eyes of many crowd. NOW WE DEY ASK UNU DIS KWESION WEYTIN MAKE SAPELE FOOTBALLERS NOR DEY GO FAR?
Posted on: Fri, 23 Jan 2015 10:25:01 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015