TOO MUCH GRAMMAR DEY CAUSE TROUBLE O... :-D I enter this - TopicsExpress



          

TOO MUCH GRAMMAR DEY CAUSE TROUBLE O... :-D I enter this Cross- Country bus from Abuja to Benin yesterday. As we dey go for road one man for back say driver I am impressed. The driver com say thank you sir. We never reach Lokoja wen the man tell driver again, driver I am impressed. The driver come thank the man again. Before we comot for Lokoja the man don thunder again say, driver I am impressed. The driver come say, thank you very much sir, I very much appreciate your compliments. The driver begin dey fire the bus dey go come dey feel like James Bond. As we reach Okene the man shout driver stop this bus, stop this bus, you mad, you wan kill person? As driver stop the bus the man run comot like Usain Bolt enter bush. We rush follow the man make we see wetin dey impress the man. Before we reach where the man dey we hear pra pra pratata pro pro! Na there we come realise say wetin the man wan tell driver be, driver I am pressed I take God beg all of una... If the English hard small, una fit talk am for pidgin. Meanwhile... I m impressed right now, make I rush discharge... I dey come :-D
Posted on: Fri, 22 Aug 2014 21:31:25 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015