The Letter wey Paul the Apostle write to people wey dey - TopicsExpress



          

The Letter wey Paul the Apostle write to people wey dey Ephesus 1:1 Na me Paul, special messenger of Jesus Christ as God want am, to the saints wey de live for Ephesus and to everyone wey de follow Jesus Christ with true-true mind. 1:2 Make you collect grace and peace from our Baba God, wey be our father and from our Lord(Oga) Jesus Christ. 1:3 I bless Baba God and the father of our Lord (Oga) Jesus Christ, wey don sama us with correct correct blessings for yonder places for heaven in Christ: 1:4 Sekop say Him don chose us in Christ even before dem lay foundation to begin build the world, so that we go dey holy; He love us sotay nobody fit blame us or ch uk chuk mouth for our matter where Him dey. 1:5 For Him mind, Him don chose us tay tay (no be today), come select us, take us as him own pikin wey him born by Jesus Christ to himself; sekop say, na dis one sweet am, do yori yori for him mind, 1:6 so na we go be the praise of the glory of his grace, na dis grace he take accept us as his own personal person. Eph 1:1-6 (9jaV)
Posted on: Mon, 02 Sep 2013 23:01:20 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015