Wetin Jon the Baptist Tok about Jisos 19- Dis na wetin Jon tok - TopicsExpress



          

Wetin Jon the Baptist Tok about Jisos 19- Dis na wetin Jon tok about Jisos wey di Ju oga kpata kpata dem wey dey for Jerusalem kon send priests and levites kon ask am, sey, “Who yu bi sef?” 20-En kon tok sey, e nor lai but tok true sey, “I nor bi di Christ”. 21-Den dem kon ask am, “Na who yu bi? Abi yu bi Elaijah”? E kon say, “I no bi Elajah”. Dem kon ask am again, “Yu bi di prophet?” E kon say, “Nooo!” 22-Den dem com ask am sey “Who yu bi sef?. Make yu tel us so we go know wetin to tel di pipol wey send us. Who yu say yu bi?” 23-Jon kon say, “ Na mi bi dat vois wey dey shout inside wilderness dey tok sey, “Make una make di road of di Lord straight oo” as Isaiah tok bifor. 24Bicos na di Farisi pipol send dem 25Dem kon ask Jon sey, “Wetin dey make yu dey baptize if yu nor bi di Christ, or Eliajah or di profet?” 26Jon kon tel dem, “I dey baptize wit wota, but among una, one persin dey wey una nor know 27E go com afta mi. I nor reach di persin wey go loose di lace wey dey en shu”. 28All dis tins kon dey hapun for Betani wen yu cross Jordan, wer Jon dey baptize pipol. 29Wen day break Jon kon si Jisos dey waka com mit am, Jon kon tok sey, “Make una look.oo. Dis na di Lamb of God wey go take di sin of di world comot. 30Na dis persin I tel una sey “Afta mi, one man go com wey big pass mi bicos E dey bifor mi. 31Mi kpakpa nor sabi am bifor but I com I dey baptize wit wota so dat God go show who Jisos bi to Isreal. 32Den Jon bear witness sey, “ I si di Spirit of God dey com down like dove from heaven, and E com land for Jisos head. 33I nor know Am bifor but di persin wey send mi com baptize wit wota tel mi sey, “Di persin wey yu go si di Spirit land for En head and stay der, na im bi di persin wey go baptize wit di Holi Spirit. 34I don si Am and I bear witness sey, “Dis man na di persin wey God select”. 35Wen day kon break, Jon com stand der wit two of en discipols 36As dem dey look Jisos wen E dey waka pass, Jon com say Look o o o, na dat persin bi di Lamb of God”. 37Wen Jon two discipols com hear wetin e tok, dem kon follow Jisos. 38Wen Jisos kon turn round, E kon si di discipols dey follow Am. E kon ask dem sey, “Wetin una want? Dem kon tel Am sey, “Oga, (wey min Tichia) wer yu dey stay?” 39Jisos com ansa dem “Make una com si am”. “So dem com si di place wey E dey stay, and dem com stay wit Am dat day. Dat taim na about 4 O’clock for atfanoon.
Posted on: Sun, 07 Jul 2013 08:40:15 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015