Telephone Conversation Between Ngige&Tinubu Leaked... Tinubu: - TopicsExpress



          

Telephone Conversation Between Ngige&Tinubu Leaked... Tinubu: Onwa weting happen now? Ngige: Good day Asiwaju Tinubu: Whats good about the day when eclipse happen for your dormot? BTW, wetin make you off your phone? Ngige: Sorry sir, I be wan call you now Tinubu: There is nothing to call me for, I hear wetin happen Ngige: But sir, hope still hope dey o Tinubu: Which kan hope be that? Ngige: The 65 units now? Tinubu: Your head correct at all? The total polling units na 4,608 and youthink say 65 go make you win? Abi u be witch? Ngige: Oga, na Plan A be that o Tinubu: Weting be Plan B? Ngige:Cancellat ion or we go court. But I wan make you activate theLagos/ Ibadan Liars make them start dey spread propaganda and dey invent stories quick quick. Tinubu: Ngige Ngige Ngige. How many times I call you? Ngige: Three times AsiwajuTinubu: Nothing go save you. I sent that short-devil called El-rufai to go rig the election. Instead make him keep e mouth shut, he announced am for Facebook/ Twitter. Na so SSS take know about am Ngige: Aha, abi wan report that short man to you sef Tinubu: No report anything. No be him make you lose. Nwoye wey campaign for just 2 weeks get votes pass you. I dey shame for you Ngige: No be like that o, Jega follow do am too Tinubu: Na lie! I told you say your people go reject you but you nobelieve. Dem reject you for 2003, 2006 & 2010. Why you think say them no go reject you again? Na same problem wey I get with Buhari weymake me no wan make e run in 2015 because Nigerians don reject am sotee I don lose count. Ngige: Make I talk true. Na Fashola make me lose this election Tinubu:For weting na? How my boy make you lose? Ngige: No be him deport my people? Tinubu:But, I be tell am make e beg now and he did. Na my boy make them reject you for 2010 too? Anyway, no be weting I call u for. I be businessman and you sabi how much I put for this election, N3.21 Bn, so I need am back in 2 weeks. I no be Chris Uba, so dont mess with me.(***line cuts***) Ngige: ButAsiwaju...hello , hello hello...ewooo! Nsogbu dikwa o! PA PA abeg get Peter Obi or Victor Umeh for fone make we make deal with thembefore this Asiwaju Private Company go destroy me with their lies!!!
Posted on: Wed, 20 Nov 2013 01:06:12 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015