1.Baba God na my shepherd, I dey kampe. 2. E make me sidon for - TopicsExpress



          

1.Baba God na my shepherd, I dey kampe. 2. E make me sidon for where plenti awoof dey flow and come put me near fine river, make my bodi dey coole like thermocool. 3. E panel beat my mind come spray am white, come dey carry me pass express... road wey righteousness dey, sake of Him name. 4. Walahi!, if I waka pass where arm robber, 419, hired killer,Boko Haram,militant, ot...okoto and juju people boku, kom even join okada pass okija shrine reach valley wey near where death dey live, my mind go strong kakaraka like zuma rock, becos you stand gidigba for my side. Your cane and walking stick nko? Na so dem dey like back bone dey giv me comfort. 5. You don prepare Egusi soup and Pounded yam decorate am with bush meat say make I chop. All my enemies shine eye dey look waa waa. You rub me for head wit vaseline intensive lotion. My cup of maltina kom dey overflow like bar beach. 6. True true, betta life, plenti awoof and mercy go gum my back till I quench. And man pikin go tanda for God house
Posted on: Wed, 17 Jul 2013 14:32:40 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015