1 of my friends invite me cum him church 2day........ & I really - TopicsExpress



          

1 of my friends invite me cum him church 2day........ & I really enjoyed d preaching, but e get 1 testimony wey d pastor of d church give wey I nor too dey comfortable wit....... Bcus right 4rm time, I b person wey b say as I dey listen to ur talk, I dey filter all d tins wey u dey talk, just to know d 1s wey correct & d 1s wey no correct...... Be u president o, doctor o, teacher o, or even pastor sef D mistake wey sum pipo dey make sumtimes b say....... Anytime dem go church, anytin wey their pastor talk, weda e correct o or not, as far say na pastor talk am, dem no dey wan argue am, bcus dem feel say pastor no fit make mistake Naim make 1 pastor d other day for South Africa order him church members say make dem begin eat grass if dem want make God answer their prayers....... & d members true true begin chop grass like cow Anyway, As I was sayin concerning d church wey I go 2day........ So d pastor say..... Everybody praise thy Lord (Hallelujah) ....... I was travelling 4rm Kogi to Onitsha last weekend, suddenly, d bus I entered collided wit a moving trailer filled wit petroleum product....... & immediately, our bus started somersaulting........ D bus was somersaulting, somersaulting, somersaulting, somersaulting, & somersaulted for good 7 times, I mean 7 good times...... & d good news is dat, all of us in dat very bus came out alive unhurt........ Praise thy Lord So, for where me sit down....... I cum dey ask myself say wen d bus dey somersault, na who count d somersaulting wey cum make d pastor know say na 7 good times?....... Na d bus driver count am? Abi na passerby count am? Or abi sef na d pastor himself personally count d somersaulting wey cum make am dey so sure say na 7 good times d bus somersault? Una Good Afternoon & Happy Sunday
Posted on: Sun, 16 Mar 2014 11:04:49 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015