99.5 WAZOBIA FM ABUJA: 9JA HOW UNA SEE AM:- National Chairmo of - TopicsExpress



          

99.5 WAZOBIA FM ABUJA: 9JA HOW UNA SEE AM:- National Chairmo of United Progressives Party (UPP) Chief Chekwas Okorie, wen him dey yarn wit tori piple say time don reach wey Ogbonge Gov’t go enta Sambisa Forest to bring back the missing girls no matta wetin happen or spoil. Him say Ogbonge gov’t dey too careful about dis matta dat is why all this terrorist gbege still dey happen bcos gov’t no want make anything happen to those girls. Dis chief still talk say make gov’t enta dia by force bcos dis girls go don suffer plenty bad treatment for d hand of these terrorist piple so e go beta make gov’t use force for the matta no mata who go die or wetin go happen at least some of the girls must return home and terrorist gbege go stop. You agree wit Oga Chekwas say make military piple enta Sambisa forest by force no mata wetin go happen, and you think say dis wan go stop terrorist gbege for Naija? Give us your reasons. LadyG (@ladygdgenius) and Oche dKing (@ochewazobia) dey in da haus. #KuleleZone #9jaHowUnaSeeAm Tel: 0709-2222-995 Twitter: @WazobiaFMAbuja Whatsapp: 080-999-30172 wazobiafm/abuja995
Posted on: Fri, 08 Aug 2014 14:19:54 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015