99.5 WAZOBIA FM ABUJA: 9JA HOW UNA SEE AM:- Today we dey talk - TopicsExpress



          

99.5 WAZOBIA FM ABUJA: 9JA HOW UNA SEE AM:- Today we dey talk about the election wey bin happen for Ekiti State on Saturday wey the piple of the state bin chose new governor for demself. The New Governor, Dr Ayodele Fayose of PDP, win the pesin wey bin dey sit-down for Chair as governor before before, Kayode Fayemi wey be APC member. Now the b4 b4 governor don go congratulate the new PDP governor, Ayodele Fayose. According to wetin we hear, the election dey free no jibiti at all, even the b4 b4 governor say anybody wey no happy with the result of the election, make e carry the matta go court but for him, the election dey okay. Now we dey ask with the way the election take happen for Ekiti State, wetin dis one dey tell you about the 2015 elections wey dey come? LadyG (@ladygdgenius) and Oche DKing (@ochewazobia) dey in da haus.. #KuleleZone #9jaHowUnaSeeAm Tel: 0709-2222-995 Twitter: @WazobiaFMAbuja Whatsapp: 080-999-30172 wazobiafm/abuja995
Posted on: Mon, 23 Jun 2014 14:13:55 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015