A MUST READ STORY ABOUT THE ORIGIN OF TFYH.!!! In honour of Mr - TopicsExpress



          

A MUST READ STORY ABOUT THE ORIGIN OF TFYH.!!! In honour of Mr Zitas bday. It all began few years ago back then in our school days. Few days b4 Zitas bday. We just finished a tuff game of football match and were comtemplating weather to go and play video game or stay on to chat for awhile. So zita said to me. Zita- jp my bday is coming up in few weeks time. Me- really!!! Choi na grooving tinz be dat na. U go celebr8 am for lodge??? Zita- I never know ooo. I still dey contemplate sha, but it depends if moni enter my hand. Me. U no need much moni, if we do am inside lodge here we no go spend pass 5k. Just buy lacaserra for everybody for lodge, den we go bring out my deck outside begin rock babes. Zita- lol u feel say e go work like dat??? Me- na wa oo for sure na. U go invite all those ur Facebook friends, u knw say u popular well for Facebook. Zita- (smiles in confidence) I get frnds for Facebook wella even pass for skul here. Infact pple wey even know me for facebook no knw say na me for real life. If dem even see me for department dem go waka pass me but me and dem na padi for Facebook. Me- hahahahahahaha choi ur popularity for Facebook don turn sumtin else. Infact if u wan contest for sug, use Facebook do ur campeign. Zita- na nice idea oo but I go like a situation where all my Facebook frnds go come my bday party. Me- really!!! Then y not have a Facebook bday parry. Zita- how??? Me- do de party online Zita- how will u now give dem drinks?? Me- lacasera is 100 naira abi? Den use de moni and buy recharge card give dem. Zita- na true oooo Me- yes na, with dat everybody will partake. Zita- na good idea be dat ooo. Na ecxatly wetin I go do. Me- we fit plan am well. Zita- what abt music? Me- no worry I go do DJ. I go dey drop music. Zita- we fit use Nnamdi do MC Me- yes na coz himself popular. Zita- I go just post am for my wall be dat na and datigboboi go just dey give us him raappin lyrics. Mikel go dey hightable. Me- even nuno self. Guy e go make brain die. ( just then igboanugo sited us all de way from Abuja lodge and decided to join our chit chat) HOD- guys wetin dey sup na Zita- igboanugo de gr8 1. (handshakes) Me- HOD himself (handshakes) how far na HOD- I just gentle. Zita- de gr8 1 see wetin me and Jp dey plan for here (narrates de whole plan) how u see am? HOD- waow kul Idea. Wen we go do am. Me- June ending. Zita bday. HOD- nice idea. I support am. Zita- later we go plan de program of de day. Me. Ok na. Make I go shower. I go cum ur room later make we play game. Zita- no wahala. Make me self I go shower. (I took my leave as HOD and zita takes der leave. Few days to de bday and exam is fast approaching). Zita- its quite obvious dat our exam will clash with dis bday event and I dont want anytin to distract me during my exams. Me- so what do we do now??? Do u want us to council it??? Zita- im not sure but what do u tink??? Me- hmmmmmm (thinking) Zita- I tink I have an idea...... .... (TO BE CONTINUED)..... De next edition on de history of de Facebook youth hangout coming ur way soon. To God be the glory. DeeJay TONYJAZZ...
Posted on: Sat, 28 Jun 2014 20:57:17 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015