A pathetic story: E get one particular resturant wey i dey chop - TopicsExpress



          

A pathetic story: E get one particular resturant wey i dey chop for G.R.A,e get one oyibo wey dey always come chop dia too....Anytime dis oyibo chop finish he go shout Hey, so i dey wonder wetin dey make am shout, i decided to chop wetin dey oyibo dey always chop so maybe meself go shout too.......when i reach dey resturant last week friday,i order wetin dey oyibo man dey chop......Dem tell me say na chicken and red wine,so i chop am but i no shout,i collect xtra plate but i still no shout......na den i just vex ask for my bill.dey waiter tell me say one plate of chicken and red wine na # 75,000 den xtra plate of chicken and red wine na #75,000......na den i shout heyyyyyyyyy.... .heyyyyyy.....h eyyyyy,i still dey shout till now.
Posted on: Mon, 02 Dec 2013 05:23:49 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015