ABRAHAM WARI MAN VS GOD. If Abraham were to be a Warri man. - TopicsExpress



          

ABRAHAM WARI MAN VS GOD. If Abraham were to be a Warri man. Imagine what d story abt Abraham and his Son Isaac to be offered as sacrifice will be. God: Abraham, Abraham. Abraham: Baba God na me tander 4 here o. Na watin dey happen na? God: Take up ur son Isaac and offer him as sacrifice 4 me. Abraham: Ha, Baba God na watin i do. U knw say i lv am wela. And u wan collect am frm me. God: do u knw am d one talking. I say take ur son Isaac to d mountain dat i wil show u and offer him to me. Abraham: i don hear i go do am. Isaac, Isaac. Isaac: yes papa. (isaac came in) Abraham: go wear ur clot we dey go out. Isaac: na 4 where we dey go? Abraham: baba God say make i offer u as sacrific o Isaac: what? Me? Why? E wan kil me? Abraham: abeg go wear ur clothes make we go make i go kil u sharp sharp. Isaac: 4 where? (he ran away) Abraham: (just as he was expecting) in d Evening God show. God: Abraham hav u done what i told u? Abraham: baba God dat naughty boy Isaac wey u giv me na since mornin we don dey find am we no si am o. God: why did he ran away? Did he knw u were goin to sacrific hm.? Abraham: no, i dont tink so. I just tel am say make e go prepar make i go kill am. Na fiam i hear. Na since then we neva si am. God: go and luk 4 him. And Abraham spend 40 year and 40 night lukin 4 Isaac. Even as we speak Isaac is stil on d run. Lol.. Who wan die?
Posted on: Mon, 17 Jun 2013 10:31:49 +0000

Trending Topics




© 2015