AKPOS FUNTIME. • U collect babe number u use chick store em. - TopicsExpress



          

AKPOS FUNTIME. • U collect babe number u use chick store em. Shey en mama na fowl? :> • U buy suya ur woman chop all the meat finish u con dey smile dey chop the onion, u be vegetarian? • U dey wit ur guy & u dey recieve diff kinds of phone calls every 5 min, yet u dey claim say u no dey cheat on ur guy. My sista, u be MTN customer care agent? • U ask a girl for what she wants, she tells you money and you are angry. Were you expecting her to say wisdom & understanding? • Ur mates pay complete fare, sit down comfortably 4 bus, u pay half dey stand n smile. Bros u b usher? • Ur gafrnd dumps u for a rich man u say she b golddiga bt ur sister do d same to anoda guy, u giv testimony for Church, sey na grace of God. Bros park well. • Since last 2 weeks, PHCN never remember ur street n una no get common Tiger gen, yet u come my house still dey borrow Jackie Chan film from me...bros na PHCN office u wan go watch am? • Yo babe get F9 parallel for WAEC, she still dey ask for Brazilian Hair of #150.000 . Were she wan fix am?, ontop that coconut head? • U have 8 tribal marks, stretch marks scattered all ova ur body yet u still want a tattoo...ah! my friend u be zebra.. • U are 6 feet tall, u still com wear 6 inches high heel shoe... se u wan whisper to God? • U dey snap inside different type of cars yet u expect ur man to believe u are not cheatin..aunty,u be mechanic? • U gather different gals picture for ur fone & yet u xpect ur gal to believe u are not cheatin.. uncle, u be photographer? • He gave u an engagement ring for over five years, e never marry u, my dear u be lord of d rings? You Can Also Add Yours.....
Posted on: Sat, 20 Sep 2014 16:30:00 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015