AMEBO ZONE: Abeg make una help advise me, my daughter of 15years - TopicsExpress



          

AMEBO ZONE: Abeg make una help advise me, my daughter of 15years for secondary school carry male condom for her bag and one day I just say make I check her books and see her performance, na so I come jam the condom for her bag. Wen I complain give my wife, she say na bcos I no dey get time for my children and she say she dey try her best to talk to dem but as the father I no dey dey around to contribute ma own share. Now I ask my daughter how comes about the condom she say na her friend own. Abeg na where I go wrong here and how I go take do things right for my haus again bcos my work don take plenty part of me? LadyG (@ladygdgenius) and oche DKing (@ochewazobia) dey in da haus. #KuleleZone #AmeboZone Tel: 0709-2222-995 Twitter: @WazobiaFMAbuja Whatsapp: 080-999-30172 wazobiafm/abuja995
Posted on: Tue, 08 Jul 2014 16:01:32 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015