AMEBO ZONE: Me and my bobo bin dey date, him come leave me go - TopicsExpress



          

AMEBO ZONE: Me and my bobo bin dey date, him come leave me go marry another pesin. After a like 8years of marriage wit the other lady dem no get any pikin gradually one thing lead to another me and him come continue dey see each other I come get belle for am. Him agree to take responsibility of the baby if I born and after I born, him dey take responsibility but al of a sudden, him come stop to dey visit me and even to bring small money to take care of the baby him no dey care again. Now my haus rent don expire, I no get any work wey I dey do, no food to eat and I carry pikin but him and hi wife dey inside their apartment dey live big life and him wife no get any pikin. Abeg wetijn make I do? LadyG (@ladygdgenius) dey in da haus. #KuleleZone #AmeboZone Tel: 0709-2222-995 Whatsapp: 080-999-30172 Twitter: @WazobiaFMAbuja @matta4ground wazobiafm/abuja995
Posted on: Mon, 28 Jul 2014 16:00:45 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015