ASUU STRIKE ADVERTISEMENT!!! Yes O! E don happen again o. Chukwudi - TopicsExpress



          

ASUU STRIKE ADVERTISEMENT!!! Yes O! E don happen again o. Chukwudi Films in association with Chukwuemeka Pictures presents anoda ogbonge movie ASUU STRIKE 2013. Dis one na movie wey pass movie ooooo. Dem no dey tell person dis 1 oooo, u must to watch am by ursef. Come hear the true story behind the whole Asuu Strike ooooo- who start am, why dem start am, who supose end am and who no gree end am ooooooo! U go c all for dis movie. Money don scatter our country ooooo, dis 1 dey ask 4 money, dat 1 say no money.....ewoOoooo Chai com c as university student dey suffer, c as crime dey increase. Girls dey born lk fowl, yahoo men dey press die...See Blood! Blood!! Blood!!! rich man no even worry. Leaders no even send. Wetin poor man go do. Kai! ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . . Suspense full am, intrigue, romance, swagger, ginger... Dat will kip u glued to d edge of ur seat .U go laff,u go cry and u go reason sef. ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . . Grab ur copy now! Starring: Kanayo. O. Kanayo as Goodluck Jonathan Pete Edochie as Nassir faggie Patience Ozokwor as Ngozi Okonjo-Iweala, Eucharia Anunobi as Ruqayyat Ahmed Rufai and Olu Jacobs as Gabriel suswan.. Jim iyke as yahoo boy, sacca na poor man oooo. ASUU STRIKE 2013!
Posted on: Sat, 05 Oct 2013 08:47:26 +0000

Trending Topics



IDA Y MUERTE DE VALERITO Nombre Manuel Varé
From Maxwell Kofi Jumah to Akosah on Alan as the man for floating
Heutige E-Mail Mitteilung der Deutschen Botschaft in Bangkok fuer
FREE Today and Tomorrow Dec 4th & 5th at Amazon Belmundus an
the re-evaluation results of B.A/B.Sc/B.Com./BBA/BCA Part-I

Recently Viewed Topics




© 2015