AUGUST 16TH, 2014. AUCHI POLY NEWS. Great Gbogbo, Great Gbagba, - TopicsExpress



          

AUGUST 16TH, 2014. AUCHI POLY NEWS. Great Gbogbo, Great Gbagba, Great Polytes, DORO MORNING. Poly-week on Point Dinner Party on Point som students Fb/Bbm status. ATM wan day charge N65 as from September 1st, 2014. for any withdraw way u make. Emefiele, na wetin u find come CBN be dis? To spoil wetin we been dey enjoy? As d Month day near, all d Studentz day................... Put ur answer. EBOLA VIRUS don day Spread lyk Fire, mak una quick day enta house mak e no burn una. A MUST READ TO ALL ND/HND/BSC ASPIRANTS: i don beg una tire soté una no wan listen2me, mak una no send money 2people way una knw no, un2 Admission mata, but una no wan hear, bkus una day eagar2 enta skul. Education na 4all, una rememba Say wen una day do una ONLINE 4 POST UTME, som People way assist una day Save una BIaO DATA 4deir COMPUTER???, Latest Research way i do, 419(fraudsters) wan tak Fraud aspirants Money, Anybody way call you, tell you say him/her day wif ur Credentials nw, say him/her day work4 MIS or ADMISSION OFFICE , say him/her wan giv u ADMISSION, mk u no believe d person. Na God day gv Admission, Bkus som guys nw adays, day use deir babe, wan tak mak Money, una no say wen guys hear WOMAN voice dem don fall bdat. I go day Post More HINTs so dat una no go fall Maga, enuf is a word to enlighten d wise. Mak una day careful. Abeg #Share to Others, way need am pass you. Mak una Warn Philipa O. Idogho, d ones way day facebook. CASOR Drama night na Bomb!!! Yestaday, for una way go, how e b? NIFES Music night, way near Campus1 gate na 21st August 2014 tym na 2pm. Na must cum. Mak u cum hear different melodious voice of Gbasky polytes Choirs. How una see d Poly-week, diz na Week of change, wr and wr una wan go?? Diz na waytn go happen today, way b Poly-week. Sat16th, na dinner party/sch &Dept activitiz,venue na Hostel Complex tym na4pm-6pm. SUG ELECTION: na Next Week. AUCHI POLY FORM: HND form neva cum out we go inform una wen due. No fall maga. SPAT form na September period, e go tak show face. No fall maga ND/Bsc CBT result neva cum, mak una day patience, wen e cum out, i go let una knw. No fall maga. Abeg mak una day try dy comment and share our post. Una happy Weekend. This na the news way we get for the day, we don cum back with alot of branded style. if u get anytin to add lyk news,advert,info,entatainment,birth wishes, abeg fil free to use d comment box or inbox #Wapjunior, beta stil Call Joe 09094408154. For our Tomorrow publication. thanx.
Posted on: Sat, 16 Aug 2014 06:18:21 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015