Abeg... make una leave we Nija pickins alone. Make man pickin - TopicsExpress



          

Abeg... make una leave we Nija pickins alone. Make man pickin caryy him ear hear better story wey dey go round. How we go fit pay children(s) fees, think about wetin go make him childrens life better, hw landlord go make tenant complete ATM...na so so draw draw money...hw we go get matches, candle or ibeta pass my neigbour, carry watch football...or somehtin...dis rivers state wahala don tire us.. D time when dem be dey tear chicken laps, wings n ngworngowr dem be tell us ? or d time when dem dey wear aso ebi, dey dance for square n share oil blocks, U dey there ? D time when dem dey monkey go church, mosque or okijas etc, dem call u ? d time wey dem dey share security votes, allowee, n Foundation pet projects, dem consult u?. D time, wey dem make dem pickins, brodas, sisttas n mamas permanent secretaries, personal assistants to senior personal assistants, n special assistants to assistant special, dem collect yr cv ? d time wey everybody turn to amnesty graduate and pot orpost graduates students..dem call yr broda? d time wey dem get more oil wells n share am with oyibo companies, dem remember yr papa or grand par tax ? d time wey dem say make we tight our belt to sacrifice,,no be 3 agbadas or five people cloth one person dey tie for waist ? d time wey u occupied, dem no talk say na pulic disturbances...so wetin come concern us now..abeg make we just dey go jeje for we service lane...ooo!
Posted on: Tue, 16 Jul 2013 15:02:36 +0000

Trending Topics