Abeg no waka for road read dis tin ho, for your own - TopicsExpress



          

Abeg no waka for road read dis tin ho, for your own good Conversation between Akpos and a rat: RAT: (With a tiny voice) Hello. MAN: Hello, who am I speaking with? RAT: Na Mr Akpos be dis abi? MAN: Yes! You are speaking wit Mr Akpos. Who is dis please? RAT: So you no recognize my voice abi? Na, me your room mate. MAN: You say what? RAT: Your room mate, Rat. I dey your room now. MAN: I beg your pardon? RAT: Which yeye beg you dey beg. I never chop since yesterday wey you waka comot. I check that place wey you dey put food I no see anything. I check the kitchen, nothing! I even check your fridge, no single food there! E be like say you wan kill me abi? No problem, I just say make I let you know say that your certificate for inside your wardrobe wey dem write LAGOS STATE UNIVERSITY, I don eat the LA comot. RemainingGOS STATE UNIVERSITY. Let me see which work you go take GOS state university find (Rat ends call). What do you advice Akpos should do? #Comment #Like #Share
Posted on: Fri, 04 Jul 2014 06:53:25 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015