Alonso no go play Confed Cup 03 Jun 2013 08:16:49 Andrew Randa - TopicsExpress



          

Alonso no go play Confed Cup 03 Jun 2013 08:16:49 Andrew Randa Real Madrid midfilda Xabi Alonso no go play for de Fifa confederation cup for Brazil dis mont afta Vicente del Bosque drop am from hin team. Afta dem rilis the final list of 23, de 31 years playa wey don tey wit de Spain team even wen dem win Euro 2008 and 2012 plus World Cup for 2010 go miss be dat, and e be like say injuri sef dey wori am small. De oda two players wey drop comot from de list na Manchester City playa Javi Garcia and Real Betis midfilda Benta Etxebarria, de kontri futobal federation yarn for statement wey dem comot. All de 23 playas wey make de list go show for Los Rozas for Madrid side on Tuesday make dem start to dey prepare, but Barcelona defenda Gerard Pique don kollect escuse make hin go house setul some famili mata like dat. De World and Europe champions get two friendli for United States wey dem get bifor dem waka enta Brazil. Dem fo play friendli wit Haiti for Miami for June 8, come jam Ireland for New York, three days afta dat one. Spain go nack head for de Confederation Cup for Group B wit Uruguay, Tahiti and Nigeria, and na dem go start de kompitishun for Recife for June 16 against Uruguay. De Confederations Cup go start from June 15 reach June 30. Na Spain squad be dis: Goalkeepers: Iker Casillas (Real Madrid), Victor Valdes (Barcelona), Pepe Reina (Liverpool) Defenders:Alvaro Arbeloa (Real Madrid), Sergio Ramos (Real Madrid), Gerard Pique (Barcelona), Cesar Azpilicueta (Chelsea), Jordi Alba (Barcelona), Ignacio Monreal (Arsenal), Raul Albiol (Real Madrid) Midfildas: Javi Martinez (Bayern Munich), Xavi (Barcelona), Andres Iniesta (Barcelona), Sergio Busquets (Barcelona), Santi Cazorla (Arsenal) Strikas: Cesc Fabregas (Barcelona), David Villa (Barcelona), David Silva (Manchester City), Roberto Soldado (Valencia), Pedro (Barcelona), Juan Mata (Chelsea), Jesus Navas (Sevilla), Fernando Torres (Chelsea). ©
Posted on: Thu, 06 Jun 2013 16:48:14 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015