Asi Ajayi shebi u come my wall come write say Nigerian soldiers - TopicsExpress



          

Asi Ajayi shebi u come my wall come write say Nigerian soldiers sight missing girls? America with their satellite wey dey see the kind of soup person cook never see am na come Nigerian soldiers abi? Una go use junk journalism, lies, hate for the president etc etc turn unaself to garbage bin wey press go dey dump their refuse/dirty. If you hear or read news, P.A.U.S.E!!! Even Brilliant Kingsley Iriogbe dey come tell me say Fed Govt hire PR agency for 1 billion dollars. Shebi na bridge dem want build for Time Square abi? Na how much be CNN wey dem dey use 1 billion dollars do international media hype? See, dollars no be naira oh! Ask anybody for here, America still dey use cent/kobo. If American want beg you money, na you got 25 cents or you got 50 cents. Them no dey beg you 5 dollars. So when una dey carry call billion billion billion,so, make una take am easy. Ogas for PR firm, if them see 200 to 300 thousand dollars per annum as Salary, them happy die be that oh. Na so Sanusi call 50 billion DOLLARSSSS una believe say person fit thief that kind money for democracy. Babangida na 12 billion oil Gulf oil windfall money we still dey worry am for till today....and na military man. I done dey tire for young men wey know book pass me wey just no want dey use their intellect. A whole Asi Ajayi read nonsense for press, instead he go read to know if na official statement before he come pollute my timeline (of course I hide the nonsense make people no go think say na me post am) he just rush come and post am 3 times. See me now? Na Chuck Hagel me dey quote Oga of everything related to the army. He done tell you say them never see missing girls. My only problem be say how we go take know sef say na the missing girls be this if them bring any 200 girls come from Chad or Cameroun? Even if them no bring any girls sef, if GEJ, Shettima just come outside say we have found the girl and returned them to their parents how we go take know if na true or lie? You know the parents wey their pikin lost? You know the pikin wey lost? You know how many if na 100 or 300 or 176? Going on two months, na still over 300 and over 200 we still dey hear like say pikin na seed (grain) of rice wey dem no fit count to know how many. Till now dem never fit ask each papa and mama is your child missing then collate the number and have an actual number of missing children. Una still dey listen to nonsense of over 200/300. If we no fit know how many lost, how una want take know if una done rescue all or them or una go approximate human beings again abi??? And later opposition and my critics go say even if it is one child yet una no know how many make we go rescue from Boko Haram. If them rescue 100 leave 80, is even if it is one child ...e still make sense? So again, NA HOW MANY MAKE WE GO RESCUE? 200? 300, 176? Because over 300 no be number. Na human being be this no be seed of corn. Nigerians, Asi Ajayi, na we dem know as 419, na we sharp. No dey fall my hand dey come my wall come type say army sights missing girls. You too sharp for that. Once GEJ, America and Shettima ready to relate, them go give una story say dem done rescue the girls and nobody fit argue because STIGMA MADE THEM RETURN THEM TO THEIR PARENTS CLANDESTINELY I must end with gbomo gbomo Shettima. He done budget hundreds of millions of naira say na to take care of the escaped kidnapped girls. Oya use you brain. DEM NEVER RESCUE THE GIRLS FINISH. THEM NO KNOW IF TOMORROW MORE GO ESCAPE, YOU DONE BUDGET HUNDREDS OF MILLIONS WEY NO BEEN DEY YOUR ANNUAL BUDGET. WHY THE RUSH? Hospital you no carry them go. Trauma expert and psychologist, CNN sef no tell us say you hire, You carry small small girls lock inside Govt House. I HOPE SAY YOUR WIFE DEY MONITOR YOU AND YOUR PAS FOR NIGHT BECAUSE UNA GO FIT GO GIVE THEM BELLE LIE SAY NA BOKO HARAM. Anyway, make una end this nonsense. Shettima, give the parents their ballance an allow the girls and Nigerians and the whole world go about regular business. #GiveBackTheirDaughters
Posted on: Mon, 26 May 2014 04:59:50 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015