Assuming you are watching football match at a viewing centre, - TopicsExpress



          

Assuming you are watching football match at a viewing centre, Chelsea vs Man U. A guy just walked in and sat next to you and the following conversation ensue: D guy: Bros how far? Na match them dey play? You: Yes nau. Shebi na im u dey watch. D guy: Ok. Abeg who dey play? You: Na im be dat na. Chelsea vs Man U. D guy: oh ok. Abeg who wear blue? You: Na chelsea wear blue. D guy: owk who com wear red? You: oooh c am nau, na man u. D guy: owk no vex. Ehm bros na 1st half abi second half. You: chai guy na wa 4 u o. Na 1st half nau. C am, na 20minutes bros. D guy: oh ok. Bros abeg wetin be scores? You: come guy. Na 0-0 na. shebi na im we dey watch. D guy: oh oh oh ok 0-0. . Abeg who cum get zero? My broda nd sista at dis junction,. Wetin u go do??.....
Posted on: Wed, 14 Jan 2015 18:58:10 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015