Backpass, November 21 Mede Mede Mede Mede Parliamentarians, - TopicsExpress



          

Backpass, November 21 Mede Mede Mede Mede Parliamentarians, I hail una ooo...anoda weekend don land so and as we dey do am, na Football Live we go carry nack una as we go crayfish waka every match venue for obodo-oyinbo. But one gbege wey go fit tear cloth be de one wey go shele for England wen Manchester United waka go meet Arsenal for Emirates stadium. Former Man. United player, Paul Scholes don dey shake ooo, e dey fear bicos for im mind, Danny Welbeck wey dem sell give Arsenal fit winshy dem on Saturday as e go wan show say e sabi tap leather and dem nor suppose sell am. Question: How u tink say de gbege go end as Scholes don dey shake like say e get malaria so?
Posted on: Fri, 21 Nov 2014 07:32:33 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015