Conversation between Akpors and father - in Warri. Father: - TopicsExpress



          

Conversation between Akpors and father - in Warri. Father: Akpors, I hear say WAEC result don comot. Akpors: Yes palee. You no go believe palee. Father: Believe wetin? Akpors: Palee, you know Emeka? Emeka, that chief pickin wey dey always hammer first since JSS 1? Father: Yes. Akpors: D guy fail! Father: Shooo? Akpors: Palee, that na small na. You know Chinedu, wey dey come teach me for this house? The guy sef fail! Father: [in shock] Why people come fail this year na? Shooo?. Nah wah o. So, wetin u get? Akpors: Palee, Shooo? Like say u no understand wetin I bin dey talk. I say Emeka fail. Chinedu fail. Where you wan see my own, I be winch?,. #Nigeria #Jokes
Posted on: Thu, 29 May 2014 21:58:09 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015