Conversation between a hungry Rat and House Owner Rat:.... (with - TopicsExpress



          

Conversation between a hungry Rat and House Owner Rat:.... (with tiny voice) hello. Man:.... hello, who am i speaking wit? Rat:.... na Mr Steve be dis abi? Man:.... yes u are speaking wit Mr Steve..., who is dis pls? Rat:.... so u no recognize my voice abi?....Na me ur room mate. Man:.... u say what?. Rat:.... ur room mate Rat..., I dey ur room now.. Man:.... i beg ur pardon? Rat:.... which yeye beg u dey beg... inever chop since yesterday wey u waka comot... I check that place wey u dey put food.., i no si anything... I check d kitchen nothing.I even check ur fridge no single food there.E be like say u wan kill me wit hunger abi..No problem.., i just say make i let u know say that ur certificate 4 inside your wardrobe wey dem write LAGOS STATE UNIVERSITY.....i don eat d"LA" comot.e remain "GOS" STATE UNIVERSITY...,Let me see which work u go take "GOS" state university find..,yeye man
Posted on: Sat, 10 Aug 2013 07:37:03 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015