Crazy boys of South London nearly scatter my enjoyment this - TopicsExpress



          

Crazy boys of South London nearly scatter my enjoyment this evening.I dey inside a friends house for surprise birthday party for his wife.I just say make I receive fresh air outside the flat.I come see two Black boys shouting at one Black boy.One of the 2 boys carry baseball bat and somtin for the backpocket.Maybe na knife or pistol,I no sure sef.Dem begin dey talk dis yeye street English :Youre fu*ked up man!Innit?I am gonna hit you hard bla bla bla.I know say wahala go happen today.I come use brain waka back to my friends flat as the other guy dey come towards me.Wetin be my own wahala?Before you go say Goodluck Jonathan,the boy enter his flat to carry his own somtin.To cut the long story short,blood everywhere,dem hit the guy in the head.Police van arrived within 5 minutes.Ambulance carry the wounded guy away and dem arrest the attacker.Police come knock our door say if we see anything.As we dey birthday enjoyment,we tell dem say we no see or hear anything.If we talk say we hear or see anything.Oyinbo police go dey ask for witness statement and dabaru our enjoyment.(Ki o ju ma ri ibi,gbogbo ara ni ogun e).Make I just dey enjoy my peppersoup jare.Crazy gang members no go spoil our fun!
Posted on: Sat, 03 May 2014 17:18:49 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015