DE-LABOURING POOR DELTANS AS LABOUR MINISTER CAME VISITING Na wa - TopicsExpress



          

DE-LABOURING POOR DELTANS AS LABOUR MINISTER CAME VISITING Na wa for this delta state govament this morning on my wall to normal morning hussling, check out the long quee of police, army, vio and different different task force agboro old men doing yeye ogboju jobs for state government and PDP minister wey wan waka enter delta state. yeye. sorry for delta sha, bros come see how one man wey wear uniform come dey carry him brother dey throw inside govament moto, for some wey bad luck jam, dem market dem carri throw inside dem moto com flog dem koboko join. some private okada sorri, d rider plus d okoada una eye see sege. bros all dos awusa aboki dem for infront of asaba modern market jus go as dem wetin eye see dem dis morning. na wetin sef how contri man labour minister wan come town an my bros dem wey govment no dey pay salari go come dey suffa like so flog com follow join some okada run liv dem machine wetin, wetin, wetin poor man no go husle again all those tas force wey collect money for som taxi driva dem today, eeen, i neva begin curse ooo. dem people wey flog person papa dem wey seize person papa okada dem wey collect earli moninin moni from road users sake of say labor minista wan enter delta state i have a question these dieing minutes qaction una wan tell me say labor minista never befor today enter asaba see finish how we town jaga jaja before? eye service dey purge oooooo
Posted on: Wed, 27 Nov 2013 19:25:39 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015