E get as e be oooo.. 1) You never pay your rent For your one - TopicsExpress



          

E get as e be oooo.. 1) You never pay your rent For your one room apartment but you carry person range rover sports dey snap pic upload for Facebook... When armed robbers locate You,you go rich by force. 2) You be girl and you ugly pass monkey and you still dey form for boys.. Sister abeg you wan marry yourself??? 3) You get Bible App for your phone and you still get Mojo for The same phone... Bros abeg which one you dey??? 4) You be houseboy and you follow Rick Ross dey sing Am the boss.. When your oga hear am You go Soji.. 5) You don write waec 7 times and you follow Lil wayne dey sing I aint gat no worries.. Abeg you come this world come play..?? 6) You never chop for 2 days and you follow sarkodie dey sing You know say money no be problem.. Abeg them swear for you?? 7)You get up to 6 tribal marks for your face with stretch marks all over your body and you still wan draw tattoo.. Abeg you be zebra..?? 8) You still be jambite and you dey tell a girl for Facebook say you dey study Med Surg for Unizik.. Abeg you deserve award jaaaare.. 9) Your current Facebook location na Europe,your school is Uniben,your tweet is from malaysia,your bbm status is Dubai,whatsap from india,2go from Liberia,Skype from America and you are asking God to locate you.. Abeg where im go start??? 10) You dey enter facebook,twitter,wha tsapp,Wechat and 2go everyday but you no fit remember where your textbook dey... Abeg pity your parents naaa...
Posted on: Wed, 03 Dec 2014 21:13:38 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015