E get dis particular restaurant wey i dey chop for warri. E get - TopicsExpress



          

E get dis particular restaurant wey i dey chop for warri. E get one oyibo wey dey always come chop there too. Any time dis oyibo chop finish, him go shout “heey!”, so i wonder wetin dey make am shout. I decide to chop wetin di oyibo dey always chop so maybe me self go shout too. When i reach d restaurant last week friday, I order wetin di man dey chop, dem tell me say na chicken and red wine, so i chop am. I surprise say i no shout, i even collect xtra plate, but i still no shout. Na then i just vex ask 4 my bill. The waiter tell me say one plate of chicken and red wine na N45,000, then d xtra plate na another 45,000 come see as i come shout heyyyyyyyyy! heyyyyyyyyy!! heyyyyyyyy!!! heiiiiiiiiiii!!­ !!… till i reach house i still dey shout
Posted on: Thu, 15 Aug 2013 08:54:10 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015