E get one particular restaurant wey I dey chop 4 NPA, E - TopicsExpress



          

E get one particular restaurant wey I dey chop 4 NPA, E get one oyibo wey dey always come chop there too... Any tym dis oyibo chop finish he go shout ' Hey', so I wonder wetin dey make am shout, I decide to chop wetin d oyibo dey always chop so maybe me self go shout too.. I reach d restaurant last wk friday, I order wetin d man dey chop.. Dem tell me say na chicken & red wine, so I chop am, but I no shout, I colet xtra plate, but I stil no shout.. na then I just vex ask 4 my bill. D waiter tell me say one plate of chicken & red wine na N75,000 then d xtra plate na another N75,000....na then I shout Heyyyyyy! Heyyyy!! Heyyyy!!! Heyyyyyyyyyyyyyy!!!!,I still dey shout till now..lol
Posted on: Wed, 02 Oct 2013 05:53:42 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015