E get wetin dey taya me for where some girls dey, them go pile up - TopicsExpress



          

E get wetin dey taya me for where some girls dey, them go pile up criteria wey guys suppose possess before them go gree accept those guys. True true, many good guys no get babes because maybe them no sabi write well or their English no tight, or maybe because them no get swag. Can you imagine, some girls no go gree date you because you no sabi spell… them never see anything na. These babes no know say most of these guys wey no meet up to their ridiculous standard, na them be the better guys. Shey na only ‘’Love and Care’’ wey girls need? Then wetin come concern mode of dressing, articulate writer and good accent for Relationships na? All those una boyfriends wey una think say na them make sense pass, unto say them dey dress well and speak well..na them dey break heart pass, walahi. E dey pain me when I see good and humble guys wey dey babeless, because of one kind mumu quality wey dem no get. Girls want boys wey dey caring, loving, humble, handsome, kindhearted, speaks well, writes well and faithful….na barawo una be, only una want all these qualities? Ole! Thief Thief. If you like make you gather criteria/qualities wey you think say a good boyfriend go get, na your wahala be that. Most of these boys wey una think say them no follow, na them go cherish una and pet una like eggs…Believe me. And I dey wonder how some girls dey judge guys base on wetin thier eyes dey see, e no make sense…them say true beauty lies within Abi, you go like get boyfriend wey fine well well and wey get money well well, still him dey cheat on you or you no dey smell the money sef? Or you go get boyfriend wey no too follow, but him get beautiful heart and your happiness na him utmost concern? Make una dey select na, wetin concern me….na disappointment una go get, I taya weda handsomeness and being faithful get connection.
Posted on: Fri, 25 Oct 2013 18:02:13 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015