Entertainment News/Updates. 27/09/2014. Report don land - TopicsExpress



          

Entertainment News/Updates. 27/09/2014. Report don land studio say dem don arraigned Tega Oghenedoro before one Magistrate for Minna yonder and dis Magistrate don draft three (3) count charges against am which includes intimidation and extortion. Tega Oghenedoro don plead not guilty to the three counts and as we dey report so, dem don remand forNiger State Medium Prison until the 14th October, 2014. D family members and community don join hands wit d guy lawyer to secure d release of the guy from krench. Report don land studio say Sacred Heart School wey dey New Rd by Chief Sowho yard don start to d shift their fence go back as dem don finally listen to Hon. Ben Igbakpa word during the demolition of illegal structures and fencing. We dey urge d school to use beta material take build d fence to avoid collapse becos we dey see say d sand dey many dey pass d cement wey unu dey use. Na advise we dey. Report reach us say the wedding wey dem do for Mosogar dey very entertaining. The bride family members just dey dance steady for rain like say d Girl win NAIRA BET. Rain nor let d party see road but things flow well. The couple too tey for House and d Boy family just dey sasoma like say dem too much. Solomon Ugbo just dey smile like say nai helep d boy pay bride prize. The food sweet but e dey smell Fuel,i just taste 4 plates of food becos i nor too hungry and na only 8 Bottles of Heineken i do. Report fly open roof enter studio say, The 90th birthday of Pa Emmanuel Uwaejuoma Wilkie for Ikomi Road na Bomb. The people wen do d cake and decorations na Pinnacle peak for Warri and d colors wen dem use make sense but dem nor arrange space for people to fit pass. Na so one girl Wen dey serve cocktails, fall with d drinks but thank God say she nor injure. Nor be small dignitaries dey d ground and d person wen M.c d occasion na Otonwe Robinson. The Chairman of the occasion na no other person than Hon, Francis Maku,dignitaries like Atose and Grace Kanone and some other big big name dey d ground. Drinks full everywhere and Food just dey flow like water, different kind of assorted meals, my long throat serious today because of the mouth watering dishes wen I dey see dey pass my eye and na so I chop 5 plates of different foods, including starch and Owo with Banga rice. Wen I con site Suya and Bole with fish, I nor con fit see space put dem,but in all i do 23 Can Oregin and 5Can Star with only 4Plates of food. Report enter studio say the party wey dem do after Okoloko Bridge for Jesse make sense die. The gbedu tight sote i nor fit sidon becos the Tent big like Bethel Baptist Church. The food sweet like mad but i nor fit eat pass 3 plates and i drink only one bottle of RED LABEL. Dignitaries full the ground wella but nor be all nai wak becos the meats dey smell Canfor and faded oil but i nor care becos nor be deir money dem use do the burial. Na Goverment own so i ready die for d meat head dan say i nor fit eat at all. Who say i nor happy today dey lie. Report enter studio say David wey dey sew Curtain for Abriba line nai marry today for Urhiapele Primary School. The marriage gada touts and Igbo boys wey nor sabi dress. Na only the Gunners fans nai make d wedding get swag becos David just dey manufacture forceful smile becos nor be small debt e don owe full ground becos of the wedding. The rice wey dem share pass my front dey smell like AMPICLOX but i just pick the meat wey small like Toothpick. David just do dis marriage take shame all e haters becos e don born finish. Report enter studio say them do one wedding for Event Galleria. The wedding too nice only say dem nor too give ke attention becos my Belle swellop like who eat hot frog. The decoration na Boko Haram bomb. The bride fine like winch why d groom just dey proud like who dey Barb Goodluck Jonathan hair. The rice na Rainbow colour becos Banga,Coconut,and fried rice nai dem give me once despite say i tell dem say i nor go chop but when i eat am,i almost quench becos the food sweet like Tofi sweet. Parking space bring quarrel for the venue today becos nor be small cars show d ground but i park my Keke for Mounting Of Fire field becos i nor want wahala. The cake make brain but e scarter like Dankuya wen i eat am. Report enter studio say wen i waka reach the marriage for Immigration Center for Shell Road i just die stand. The wedding tough but the Cake designer get luck say i nor catch am becos the cake dey smell Owo Soup. The drinks nor too cold but dem dey ohk and i gbadu the DJ die becos e try but the wakis nor too go round and rain scata d venue for the couple. I tire for Rice becos na black jellof dem cook. I use God beg the groom make e nor offend the Bride for marriage becos only the girl eyes almost fall me when i wan pick money wey dem dey spray me becos of my I.D card wey pipo see. The party too much,i nor quick know i for nor eat all those food wey i chop,wen deprieve me,wey make me nor attend many Parties. Abeg wetin i go eat or drink to stop Stooling? God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 27 Sep 2014 19:53:00 +0000

Trending Topics




© 2015