Facts Of Life........LMAO •You collect babe number you use - TopicsExpress



          

Facts Of Life........LMAO •You collect babe number you use chick store am. Her mama na fowl ? • U buy suya ,your woman chop all the meat finish you come dey smile dey chop the onion, U be vegetarian? • U dey wit your guy , dey recieve different kinds of phone calls every 5 min, yet you dey claim say you no dey cheat on am... My sista, you be MTN customer care agent? • U ask a girl wetin she want from you and she asked for money and you come dey vex...you dey expect make she ask for wisdom and understanding? She be Solomon? • U dey carry your girlfriend go club, wen you don marry her finish, you dey expect make she stop clubbing, My broda are you a learner? • Ur girlfriend dumps you for a rich man you say she be gold digger, but your sister do the same to anoda guy, you give testimony for Church Say na Divine intervention..... Bros park well! • You get F9 parallel for WAEC, still you dey ask for Brazilian Hair of N150.000 . Abeg where you wan fix am?, on top that coconut head? • U get tribal marks, stretch marks full your body yet you want tattoo...ah ah! My friend you be zebra? • U are 6 feet tall, you still come wear 6 inches high heeled shoe... shey you wan whisper to God? • U dey snap inside different types of cars yet you expect youur man to believe you no dey cheat..... Babe you be mechanic? • U gather different girls picture for your phone and you expect your gal to believe you dey faithful.... Uncle, you be photographer? • He gave you an engagement ring for over five years, he Never marry you..... My dear you be lord of the rings? •You dey pay your babe wey dey university school fees and yet you never write JAMB, you be Scholarship board? •U are 18yrs and your sugar daddy is 70yrs old and you stil dey call him BABY, My sister na your ANCESTOR? •Your babe is eating ice cream...youre drinking pure water... Please my guy Are you diabetic? •U claim say you dey do fasting and prayer but you come vomit fufu and egusi soup. Omo you be magician? HAPPY WEEKEND PALS
Posted on: Sat, 25 Jan 2014 11:47:09 +0000

Trending Topics




© 2015