Finally the new NIGERIA PIDGIN ENGLISH BIBLE is out. one of the - TopicsExpress



          

Finally the new NIGERIA PIDGIN ENGLISH BIBLE is out. one of the popular chapteris psalm 23, which reads 1. The Lord na my shepherd, i dey kampe. 2. E make me sidon for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi thermacool. 3. E panel beat mai soul Come spray am white, Come dey lead me dey go Through express road of righteousness sakeof Hin name.... 4. Walahi!, if I waka pass where arm robber, 419 and juju people boku, come even join boko haram reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko ? Na so dem dey like back bone dey comfort me. 5. You don prepare good food ontop d table make I chop. All mai enemies dey look waa waa. You rub me for head wit vaseline intensive lotion. mai cup na River Niger wey overflow hin bank. 6. True true, betta life and mercy go gum mai back till Iquench. And man pikin go tanda for God house from lai lai to lai la Can somebody shout halleluyah
Posted on: Thu, 13 Jun 2013 05:50:36 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015