Fo blesin I go bles yu, an fo taimsin I go taims yur shidren - TopicsExpress



          

Fo blesin I go bles yu, an fo taimsin I go taims yur shidren shidren as stars take plenti fo up, an as san san plenti fo bish; an yur shidren shidren go kolorbi di enimi gate. (Genesis 22:17, pigin vashun) Awa God nor dey make nois. Eni tin wey Him sey He go du, na wetin Him go du. Luk wetin Him tuk fo up; Him sey fo blesin own, Him go sama yu, an Him go taims yur shidren shidren. Dat wan mins say Him no go jus bles yu den liv yu, bort sey yur shidren go kontinew tu enjoi am. Maybi wan pesin dey say hau dis wan take konsain mi? I go te yu. Yu beta go len hau tu ron cos yu go ron taya. Frum tode an fo di rest of yur laif, na so so blesins go dey pursue yu. God go sama yu an yur shidren shidren wit blesins yanfu yanfu an yur blesins go full trowey, in Jesus name. Make yu jus dey hapi dey go, bicos e go onli beta fo yu! E go beta fo yu, Hiya lefuz!
Posted on: Fri, 27 Sep 2013 12:09:32 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015