For our house we dey chop well-well,we dey chop. God don butter - TopicsExpress



          

For our house we dey chop well-well,we dey chop. God don butter our bread, come sugar our tea.He don bless us so much with food sote all the domestic and international animals wey dey our house dey form Mofasa. Make you for take know say I nor dey lie, the rats wey dey our compound dey flex, dem be like bull dog. Our dogs? Dem be like Lion.Our chicken dem nko? Dem be like Kangaroo! All the food wey we eat remain naim dem dey eat. We sef be like puff-puff, our body dey shine, e dey shine pass 60 watts light bulb. If you never still believe me, come visit me for my house for Jigagus street. Yes, things don dey better for our area now. Government don put Kolotar for our road, come cover our gutters well-well. No more mosquitoes, but the one wey manage show, for him small mind na London e dey.
Posted on: Sun, 29 Sep 2013 17:54:54 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015